Teaching the English Language Using Nigerian Pidgin

 INSTALLMENT VS INSTALLMENTALLY




Bros, I greet you. I greet the Sis for that corner. Help me touch that man for that angle. I greet you too, Sir.


Make una hear me!


You see the word "INSTALLMENTALLY," abeg, I no wan hear am from una mouth again when una dey speak English. Make una no use am even when una dey write in English too!


E fit affect my mental health and I no wan run mental. 😩


The correct word na "INSTALLMENT."


* I paid Pablo off "installmentally" and cut ties with him. ❌


* I paid Pablo off in "installments" and cut ties with him. ✅


If I hear "INSTALLMENTALLY" again, I go mooove oh! I don mooove!


© Honesty Ogbonna


Comments

Popular posts from this blog